Monday 24 November 2014

Harmattan don come back again o

Harmattan don come back again o. For those of una wey no do geography for school, Harmattan na dat dry dusty wind wey dey always travel from North Africa to come do holiday every year for west Africa within late November to early February. E dey always travel pass through the dry sahara desert where e dey pack dryness and dustiness follow body. 
I swear to God harmattan show some people pepper last year for naija. I no even know which one harmattan dey sef, from too much cold in the morning and nights to too much heat in the afternoon. No be dat one be my problem sef because the way some children body go dey dry and white like say dey wan act as ghost for nollywood movie just dey make me fear. Some people legs go cut come dey tear bedsheet like say na razor blade. Sometimes cloths go just dey shock d owner like say na electric because of harmattan.  

Some people dey happy if harmattan dey come because dey know say christmas don near, infact one of my friend last week talk say she don dey feel the christmas wind already- me I knw say na harmattan she dey talk about. 
My own advice for una be say;
  •         Buy wet lips o. if you no get money, use Ororo (groundnut oil)
  •       Buy the biggest size of Vaseline because your expensive cream no go fit deliver you from d harmattan spirit
  •     If you never get cardigan, u don enter wahala for morning and night cold. Make sure you get the thickest, but remove am before afternoon heat go catch u o.



1 comment:

  1. Internet Positif adalah kendala utama yang membuat kamu kesulitan menjangkau situs judi online seperti S128 Poker. Tapi sekarang kamu tidak perlu khawatir akan hal tersebut karena sekarang sudah ada Situs Alternatif LiveChat S1288Poker yang akan mempermudah kamu dalam konfirmasi deposit dan juga withdraw (Baca Selengkapnya...)

    ReplyDelete